Wednesday, September 4, 2019

A Star - Nosa

Nosa - A Star
Nosa - A Star cover pix


A Star Lyrics
[intro]
ooooh ooh
yeah yeah yeah
hmmm
lalal la lalala x3ce

[verse 1]
I sabi dey sing with sweet voice
My song song dey make people dey rejoice
My broda sabi how to make noise
stand up comedian na im career of choice
My neighbour sabi how to dance (dance)
If you watch im performance you must clap your hands (hands)
Another one sabi football (wow)
We dey tell am sey one day you go make us proud
God give you something wey dey make you special
And many things wey go need your attention

[pre-chorus]
So, no hide yourself again
Because I know that God has made you a star

[chorus]
( a star a star a star) ooh oh oh
( a star a star a star) broda believe sey eh
( a star a star a star) broda believe sey you be star
( a star a star a star) God has made you
( a star a star a star) Made you a star
( a star a star a star) sista believe sey you be star

[verse 2]
If na only to sweep ground you sabi
E no mean sey na there your life go reach
And if you look yourself deep you go see
Sey you fit open company wey dey clean the streets
Bros e no matter wetin you sabi do
Another person get the thing wey im sabi too
So, swallow your pride and get to work
Open your ears make you hear wetin my song dey talk
God give you something wey dey make you special
And na for good no dey use am for evil

[pre-chorus]
So, no hide yourself again
Because I know that God has made you a star

[Chorus]
( a star a star a star) aaah aaah ah
( a star a star a star) you're a star
( a star a star a star) yeah yeah brother believe sey you be star
( a star a star a star) you're a star, God has made you to be
( a star a star a star) made you to be a star
( a star a star a star) sista believe sey you be star
( a star a star a star) no let am hard you to believe, woo wooo
( a star a star a star) a star
( a star a star a star) sista believe sey you be star

[bridge]
I no dey try to be like another person
I only try to maximize my own potential
Wetin I get no be for competition
God give some five, some two
And to some, he gave one
lalala la lalala x2ce
Whoever you are
Know that God has made you a star

[Chorus]
( a star a star a star) aaah aaah ah
( a star a star a star) you're a star
( a star a star a star) yeah yeah brother believe sey you be star
( a star a star a star) whether na hair you sabi do
( a star a star a star) whether na cook you sabi cook
( a star a star a star) No be for evil na for good
( a star a star a star) whether na book you sabi write
( a star a star a star) whether na boxing you dey fight
( a star a star a star) brother believe sey you be star
( a star a star a star) whether na kpako school you go
( a star a star a star) whether na kettle you for go
( a star a star a star) sister believe sey be star
( a star a star a star)
( a star a star a star) Just Believe
( a star a star a star) brother believe sey be star

[outro]
lalala la lalala x3ce


WATCH VIDEO

No comments:

Post a Comment